MY PIDGIN POETRY BY EMMALIZER

 



MY PIDGIN POETRY

BY EMMALIZER


D way I waka pass,

No body be tell me say,

Na who wise go wise,

Shebi I no need to ask,


As d bottles full casket,

Na to dey launch one after d other,

Brother men, no reason am,

Na person wey don belleful,

Dey drink full stomach,


Na wisdom akpos talk say e get,

No lies,

Wen you think say u tear eyes,

Akpos no know say him eyes just dey open,

 

Him guys wey dey bill am on a stead,

Dem dey grind for deir investment,

Dem don acquire one or two for their mama,

Dem don dey make arrangements to put on rings,

Dem don dey plan to get another leg,


Ahh, the matter weak the street,

Baller wey no sabi ball,

Wen d real ballers show,

Akpos be like jelly fish,


Na so cold catch brother man,

Na anger Akpos take begin to drop him baller friends,

You hit once, no be assurance,

Na twice person dey tall,


E dey alright,

That one no mean say u go go left,

Na wisdom make Solomon reign sweet.

Dey try reason too.


©Emmalizer


Comments